9ja FlavourNigeria Football

Etebo no fit tap ball against Germany today, e dey pain am

Dream Team VI sabi striker, Oghenekaro Etebo no go fit tap ball for Naija wen dem jam Germany for semi-final of men’s football event for Rio 2016 Olympics on Wednesday, dem doctor don confam am.

De guyman wey be say na hin don tear net pass for Naija for de event no go fit play today match as hin no see de quarter-final sef play becos hin bin wounjur for Naija last match for group against Colombia wey dem lose 2-kondo.

 

“E really dey pain Etebo say hin no go fit tap ball against Germany. Hin don yarn hin teammates say na bad tin be dis and hin no dey joli for am at all to miss quarter final and semi like dat,” one oga boss wit de team relate African Football.

“Hin yarn say hin go support hin guys wen de match start and na all hin fit do be dat.

“Etebo get confido say Naija go beat Germany wella o. Hin even dey hope say hin go play for final sef.”

Etebo don tear net five times for Olympics dis year. 4 against Japan and 1 against Sweden for group stage..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x