9ja FlavourNigeria FootballNigeria Professional Football League

LMC don fine Wolves & FC Ifeanyi Ubah becos of fans gbege

Naija Professional Football League (NPFL) clubs Warri Wolves and FC Ifeanyi Ubah don chop League Management Company (LMC) hammer ontop say dem no fit control dem fans for league matches wey don shele.

Wolves go tap dia next three matches for home behind gate wey dem lock.

lmc-league-management-company

Although dem also fine dem one million Naira becos of fans palava for de game wey dem follow Wikki Tourists play wey end 1-1 and dem go pay 750,000 for oda gbege and 1.25 million naira for attack ontop match officials.

Wolves go lose 2 points from all de points wey dem don gather  for table dis season.

As for FC Ifeanyi Ubah, dem go pay fine of 750,000 naira after dia fans sef attack referee for match wey dem draw against Sunshine Stars for dia house. Dem even chase de referee take reach hin hotel dat day.

Naija Referees Association (NRA) sef don talk say dem don tire for all dis wahala and dem no go officiate matches for NPFL again as dem title all de wahala wey full ground now “renewed attacks”..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x