9ja FlavourNigeria Football

Na Ibadan & Kaduna go host Federation Cup semis

Naija Football Federation don yarn am say na Ibadan and Kaduna go host dis year semi-finals of Federation Cup for September 18 and 25.

FC Ifeanyi Ubah go follow Crown FC wear one trouser for de first semi on 18 for Ahmadu Bello Stadium, Kaduna, while Nasarawa United wey play for last year final go follow Enyimba FC fight am to enta final for Adamasingba Stadium, Ibadan on September 25.

Clubs wey win for semi finals go play for final inside venue wey NFF let all man know.

Lago bin host de last four finals for Teslim Balogun stadium and dem fit host am again dis year.

De women’s Federation Cup semis go shele for Owerri and Enugu for September 25..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x