9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Naija players no go fit tap ball for Premier League again becos of FIFA ranking

Naija players wey dey ball for England go get gbege for dem head ontop work permit mata if Super Eagles no dey for top 70 teams inside FIFA ranking.

Na sabi pipu for football mata yarn am so.

De latest ranking wey FIFA release put Naija for number 70 and de rule be say na only players from countries wey dey inside top 70 for FIFA ranking dem go consider for work permit beside players wey com from Europe.

download

Plenty Naija sabi players dey ball for England and na sand sand be dis for inside dem garri as Naija next matches wey dem go play na tough ones. Super Eagles dey group B for World Cup qualifiers wit Cameroon, Algeria and Zambia.

E mean say players like Kelechi Nwakali wey just join body wit Arsenal, Umar Aminu wey Hull City dey hin mata and Wilfred Ndidi go dey sweat now.

Oda Naija stars wey dey for England as professionals na Odion Ighalo (Watford), Isaac Success (Watford), Ahmed Musa (Leicester), Kelechi Iheanacho (Manchester City), John Obi Mikel (Chelsea), Alex Iwobi (Arsenal) and Victor Moses (Chelsea)..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x