9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

How Naija Players take do for Premier League first week

Leicester 1 – 2 Hull

Super Eagles assistant skippo, Ahmed Musa, play hin first Premier League match for Leicester City as dem lose 2-1 to Hull City for inside dem own backyard. Hin play de full match.

Southampton 1 – 1 Watford 

Odion Ighalo dey inside de game for 80 minutes befor coachie use Ikechi Anya replace am. Success Isaac wey be record signing for Watford no fit play for de match becos hin wounjur.

Manchester City 2 – 1 Sunderland

Kelechi Iheanacho enta de match for 10 minute to wen referee go fire final whistle. Hin enta for Gael Clichy for de match. De 20 years pikin bin get som chances to increase lead for City but Sunderland goalie no gree am.

Arsenal 3 – 4 Liverpool

Alex Iwobi do sweet assist give Theo Walcott to score for 31 minute befor dem comot am for Alex Oxlade-Chamberlain for 59th minute. But Arsenal lose de match sha.

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x