9ja FlavourNigeria Football

Naija waya Honduras win bronze for Rio 2016

De Dream Team VI of Naija kolobi bronze after dem waya Honduras 3-2 for third place match for Rio 2016 Olympics football event on Saturday.

Skippo Mikel John Obi assist all de goals as Umar Sadiq tear net two times and Aminu Umar sef no dull hinsef for goal level.

Na Naija first tear net three time befor Honduras wan try winchi de bronze wey Naija suppose win as dem tear net two times and e wan be like say dem go equalise.

But e no happen and de Samson Siasia boys smile go house wit de bronze ontop every gbege wey dem bin get befor and during de competition.

For de final match wey shele after Naija match, Brazil claim oga boss over Germany as dem win 5-4 for penarity. Na Neymar, wey bin don tear net wit beta free kick for normal time, score de last pena go give Brazil de medal wey dem neva win befor for dem history..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x