9ja FlavourNigeria Football

NFF don release names of pipu wey wan chop Super Eagles coachie

De Naija Football Federation (NFF) don let all man wey dey gbadun football for de country know de name of coachies wey wan chop oga boss for Super Eagles.

De coachies wey submit application to coach de team wey dey find how dem wan graduate from tough group wey get Cameroon, Zambia and Algeria com qualify for World Cup wey go shele for Russia for 2018.

NFF don yarn am yestaday say na former assistant coachie Salisu Yusuf, Tom Sainfeit plus including Paul Le Guen dem dey do exam for to see who go com later be boss.

Cm2mEklXgAEncLC

NFF yarn say dem go do interview for all of dem on Monday. Na 20 people bin submit CV to wan coach Naija but NFF pipu chook knife for de list cut am reach only three pipu.

See oda pipu wey bin submit application: Giovanni Solinas, Saintfiet, Hey Antoine, Mark Wotte, Yusuf, Ernesto Paulo Calvinho, Dorian Marin, Le Guen, Miodrag Jesic, Perry Hansen, Ove Pedersen, Adebayo Lateef Kola, Sylvanus Okpala, Peter Ijeh, Vladimir Petrovic-Pizon, Lodewijk de Kruif, Kenichi Yatsuhashi, Bjorn Frank Peters and Ricki Herbert.

Belgium pikin, Saintfeit na former coachie of Togo national team and hin don coach Namibia, Zimbabwe, Ethiopia, Yemen, Malawi, plus including Qatar U-17 team, Young Africans FC of Tanzania and Free State Stars FC inside South Africa.

 

As for Le Guen wey be say dem don write am for Wikipedia say hin don chop de Naija coachie job last week (na only God sabi how dem take know o), hin don coach wella for France for Rennes, Lyon, PSG plus including Glasgow Rangers wey dey Scotland.

We own Salisu Yusuf don coach Kano Pillars, El Kanemi Warriors and Enyimba FC befor and na hin be caretaker coachie for de play play matches against Mali and Luxembourg for May..

 

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x