9ja FlavourNigeria Football

NFF go announce Super Eagles technical adviser for August

Naija Football Federation (NFF) don yarn all man say dem go announce new Technical Adviser for Super Eagles for August.

NFF executive committee bin give don tell de technical and development committee say dem get seven days to yarn all man de new Technical Adviser, dat one na last week but dem fail patapata after Paul Le Guen bin open mouth talk say hin no want Naija job.

Chris Green wey be oga boss for de committee wey dey do all de test and look-look for coachie and other tins for NFF don yarn am say dem no wan do all de mistake wey dem do de last time so dem need take small time again.

Hin yarn say dem don do interview for all de coachies wey dem don consider and all man go know de new technical adviser for August.

NFF don already announce am say Salisu Yusuf go be de Chief Coachie and hin go follow de technical adviser wey go be oyinbo work to helep Naija qualify for 2018 World Cup wey go shele for Russia..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x