9ja FlavourNigeria FootballNigeria Professional Football League

NPFL All-Star players wey go tap ball La Liga friendlies don start training

Seventeen NPFL All-Star players don land for Abuja dey train ahead de La Liga friendlies wey dem go follow Valencia and Malaga play befor La Liga season go start.

Kano Pillars skippo Rabiu Ali, CHAN Eagles players Ifeanyi Matthew and goalie Ikechukwu Ezenwa dey among players wey dey camp now now and dem take part for first training wey shele on Tuesday.

NPFL logo

Meanwhilly, Niger Tornadoes striker Gabriel Wassa don collect permit to take comot from camp becos of gbege wey dey wit hin international passport.

Coachie Salisu Yusuf plus including goalie trainer Ike Shorunmu bin dey dia for Abuja on Tuesday dey train de boys.

Oda players wey dey wit de team now na Jamiu Alimi (Kano Pillars), Charles Henlong, Alhassan Ibrahim ‘Muazam’ (Wikki Tourists), Ismaila Gata (Niger Tornadoes), Ifeanyi Ifeanyi (MFM), Austin Oboroakpo (Abia Warriors), Kelechi John (Plateau United) and Okiemute Odah (Lobi Stars)..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x