9ja FlavourNigeria Football

Rio 2016 Olympics: Naija go follow Germany enta one trouser for semi on Wednesday

Skippo Mikel John Obi and Aminu Umar tear net as Naija waya Denmark 2-kondo to graduate enta semi-final of Rio 2016 Olympics for men’s football event as e take shele for Rio.

So as e be now de Dream Team VI go follow Germany get beta fight for pesin wey go enta final on Wednesday.

De match go tough wella becos Germany sef no com Rio com sleep at all. Dem kpokpo Portugal 4-kondo for dia own quarter-final match but de Olympic Eagles no go shake ontop dat level becos dem sef get beta sabiness for dia side.

Oghenekaro Etebo wey tear net four times for Naija first match against Japan fit com back com tap ball for dat match and hin go add sabiness to de attack line up wey Aminu Umar, Sadiq Umar and Imoh Ezekiel tanda put already.

Pipu wey dem need to mark wella for de semi final na Arsenal pikin, Serge Gnabry, Matthias Ginter, Davie Selke plus including Philipp Max. All dis players tear net for dia quarter-final.

De semi go shele for Corinthians Arena inside Sao Paolo on Wednesday. Sports Ration go let una know de confam time for de match ontop twitter very soon..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x