9ja FlavourBasketball

D’Tigers skippo Oyedeji no wan follow Naija go Rio Olympics again

Naija senior men basketball team skippo, Olumide Oyedeji, don seke and hin yarn say hin no dey go 2016 Olympic Games again ontop personal mata.

Oyedeji, wey be say tap ball for Naija for de first time for World University Games wey shele for Italo for 1997, don do U-turn from de events wey go shele for Rio de Janeiro for Brazil.

IMG_9526

De guyman yarn say hin get oda important mata to look after for hin family and hin go comot becos hin no want make hin own koba de team wey wan do well for Rio.

But confam report wey dey reach us talk say de skippo go later enter Rio when hin don finish wit de gbege for hin family. Na de International Olympics Committee Career Programme fit make am happen so.

Oyedeji, wey do skippo for de team when dem qualify for Olympics wit de AfroBasket win last year, bin dey part of de team pre-Olympics tournament wey shele for China and hin don wish hin team mates dem success.

Anoda confam tori wey Sports Ration don gather na say Oyedeji name bin no dey de list of 12 players wey go travel go Brazil befor. Say na reserve list hin name bin dey. Dat one mean say hin only fit helep Naija tap ball if one of de players dem get wounjur. Maybe na wetin vex de guyman be dat sha.

D’Tigers dey inside de same group wit Argentina wey dem bin waya for padi-padi game last week, Croatia, Spain, Lithuania, and landlords Brazil..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x