9ja FlavourNigeria Football

Kadiri Ikhana dey reason retirement from coachie job

Former coachie of Shooting Stars Kadiri Ikhana don open mouth yarn all man say hin dey reason to retire from coaching job.

Ikhana, wey don coach Naija women team Super Falcons and Enyimba FC befor, bin comot for 3SC of Ibadan exactly 3 months and 18 days to today after Akwa United waya hin team 2-kondo for NPFL dis season.

“I be coachie wey no get job right now and if I kolobi one later I go do wetin I always dey do. E simple like dat,” Ikhana relate.

Ontop amebo say hin fit retire soon, de coachie yarn say: “Since I don comot for Enyimba I neva open mouth yarn dat kain tin. I tink about am sha but I neva make up my mind. But I go reach dia soon.”

Amebo don dey go round say na de guyman go be Ikorodu United next coachie but hin no gree confam am..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x