9ja FlavourNigeria Football

Siasia don release name of players for Rio Olympics, Mikel dey, Awoniyi no dey

Naija Under-23 team coachie Samson Siasia don send names of players wey go helep Naija tap ball for 2016 Rio Olympics to FIFA.

Na 22 players names dey dia and 18 pipu dey de squad proper-proper but four pipu dey for stand-by.

John Obi Mikel, wey Chelsea midfielder, make am enter de list as one of de 3 players wey dem age pass 23 years but hin no dey wit de team now. Hin dey Austria dey follow Chelsea players dey train.

DSC_0945-1

Pipu wey no make de list and Naija football fans no dey joli for am at all na Arsenal pikin Alex Iwobi, Kelechi Iheanacho wey dey tap ball for Man City and sabi striker Odion Ighalo.

But surprise everybody as Taiwo Awoniyi name dey for stand-by.

 

Naija go follow Japan, Sweden and Colombia tap ball first for group stage for de Rio Olympics wey go start next month for Brazil.

De full squad plus including shirt numbers, positions, dates of birth

1 Daniel AKPEYI Goalkeeper 8 March 1986

2 Muenfuh SINCERE Defender 28 April 1998

3 Kingsley MADU Defender 12 December 1995

4 Abdullahi SHEHU Defender 12 March 1993

5 Saturday ERIMUYA Defender 10 January 1998

6 William EKONG Defender 1 September 1993

7 Aminu UMAR Forward 6 March 1995

8 Oghenekaro ETEBO Midfielder 9 November 1995

9 Imoh EZEKIEL Forward 24 October 1993

10 John Obi MIKEL Midfielder 22 April 1987

11 Oluwafemi AJAYI Forward 29 January 1996

12 Popoola SALIU Midfielder 7 August 1994

13 Sadiq UMAR Forward 2 February 1997

14 Okechukwu AZUBUIKE Midfielder 19 April 1997

15 Ndifreke UDO Defender 15 August 1998

16 Stanley AMUZIE Defender 28 February 1996

17 Usman MUHAMMED Midfielder 2 March 1994

18 Emmanuel DANIEL Goalkeeper 17 December 1993

Stand By List

19 Sopuruchi DIMGBA Forward 29 March 1993

20 Taiwo AWONIYI Forward 12 August 1997

21 Saviour GODWIN Forward 22 August 1996

22 Yusuf BALA Goalkeeper 22 December 1996

 

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x