9ja FlavourNigeria Football

Na Olympic gold be my target – Etebo

Naija sabi boy and hero for de 5-4 flogging wey Dream Team VI dash Japan on Thursday for Rio 2016 Olympics football event, Oghenekaro Etebo, don yarn say na gold hin wan wear for hin neck when all de Olympic mendemende finish for end of August.

Etebo tear net four times for de game wey shele for Arena de Amazonia inside Manaus, but de guyman yarn say hin goals be ordinary smoke wey go just blow away if gold no follow am.

De befor-befor Warri Wolves player say de focus for am and de team na gold for Brazil and if hin chop top scorer’s award go just be salt to de delicious food to make am sweeter.

“To score all de goals for dis Olympics and we no win gold na just waste of effort o. So dat one no be my target (to win top scorer award). E go totori my belle to see say my effort carry de team to chop success o, but if e no make us carry gold ehn, I no want abeg,” naso Etebo take relate for de post-match meeting wey shele.

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x