9ja FlavourNigeria Football

AFCON Qualifier: Super Eagles camp go open on Monday

Naija Super Eagles go start to dey train for de 2017 Africa Cup of Nation qualifier match wey dem wan follow Tanzania play on Saturday.

NPFL players like Emmanuel Daniel (Rangers), Ikechukwu Ezenwa (Ifeanyi Ubah) and Jamiu Alimi (Kano Pillars) go don dey camp on Monday, but dat one na afta dia NPFL matches dis weekend.

Chelsea player Victor Moses wey tear net for hin club for 3-kondo win against Burnley go dey dia too and we hear am say skippo Mikel John Obi go land for Naija on Tuesday too.

De tin be say even if Naija use all dem power beat Tanzania faint de result no mean anytin as de two countries don ja already as na only Egypt qualify enta 2017 AFCON from Naija group.

Sports Ration bin also gather am say new coachie Gernot Rohr wey go dey in charge for hin first match for Naija go don tanda gidigba for de camp for Uyo dey wait all de players on Monday..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x