9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Awoniyi don enta NEC Nijmegen on loan from Liverpool

Naija sabi striker Taiwo Awoniyi don enta NEC Nijmegen for Netherlands on loan for one year from Premier League club Liverpool.

De 2013 FIFA U-17 World Cup winner bin join body wit Liverpool last year for permanent level befor dem borrow am to FSV Frankfurt for de whole of last season.

Na only one goal hin see score for 14 times wey hin wear dia jersey but hin gats go on loan again as per say hin dey get work permit palava for Liverpool.

De striker no even fit make de Dream Team VI wey helep Naija kolobi bronze medal for Rio 2016 Olympics dis month..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x