9ja FlavourNigeria Football

Bangladesh wan kolobi Saintfeit from Naija as head coachie

De Bangladesh Football Federation (BFF) don dey try dem best to kolobi Tom Saintfeit as head coachie of de Bangladesh national team.

Saintfeit na one of de oyinbo coachies wey dey for 3-man shortlist of coachies dem wey fit chop head coachie of Super Eagles of Naija.

Tom Saintfiet, coach  of Malawi  during the 2013 Cosafa Cup quarterfinal football match between Zimbabwe and Malawi at the Nkoloma  Stadium in Lusaka, Zambia on 13 July 2013. ©Gavin Barker/BackpagePix

As per amebo wey dey ontop African Football, Bangladesh don already follow Saintfeit word and de guyman dey de country now sef.

Saintfeit even confam am sef say hin dey Bangladesh now sef but hin dey wait for Naija make dem open mouth talk first befor hin sign.

“Yes o, I dey Bangladesh now now and dem don gimme offer o and dem even dey wait make I sign sef. But me dey wait for wetin NFF go yarn first o make I no lose for two places,” naso Saintfeit take relate.

As per amebo wey dey everywia for Naija media, NFF don already reason Paul Le Guen as de coachie for Naija and dem bone Saintfeit.

Dat one go be one of de reasons why de oyinbo don dey reason hin future mata wella travel go Bangladesh..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x