Foreign LegionNigeria Football

Belle dey totori Ahmed Musa as hin join body wit Leicester

Super Eagles sabi player Ahmed Musa don finally join body wit Premier League oga boss dem, Leicester City on Friday as de club dash am four years contract.

De 23 years pikin enter de Britico club from CSKA Moscow for 18 million pounds wey be record money wey Leicester don use sign player for dem club career.

Cm2eCa8WcAADjC3

“My belle dey totori me say I don join body wit Leicester city no be small. As for me o na one of de best clubs be dis,” naso Musa take relate Leicester website.

“I join body wit dem becos dem be one of de best for Premier League and dem dey do like family.

“I no fit wait to see de fans for season wey we just wan enter and I really wan make dem joli.”

Hin go go follow de team train for training camp wey dem get for Austria next week..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x