9ja Flavour

CSKA Moscow coachie don confam say Ahmed Musa dey comot

CSKA Moscow coachie Leonid Slutsky don confam at last say Super Eagles winger Ahmed Musa go comot for de Russia club go English Premier League.

And as e be now e be like say na Leicester City de former Kano Pillars player go use do bus stop after all de transfer amebo and waka waka.

ahmed-musa-of-cska-moscow_1fmrlxrw4ul5b18tm20aft0mal

Leicester don wan kolobi de player since January but CSKA bin dey do strong head ontop de deal mata.

As per amebo wey we dey get for Sky Sports West Ham and Southampton sef don join dey reason Musa mata.

Musa don dey ball for Moscow since 2012 and dis last season wey just pass na hin best since as de forward tear net 13 times for 29 Russian Premier League games.

 

“Hin (Musa) go comot for here on Tuesday,” Slutsky relate amebo pipu for Russia on Sunday.

“And if una reason am well una go see say hin style match English football wella and na dia hin dey go..”

 

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x