9ja FlavourNigeria Football

Dream Team VI wey suppose play on Friday neva fly go Brazil

As per amebo wey we dey get for Daily Post, de Naija Olympic team wey suppose follow Japan tap ball for dia first match for Rio 2016 men’s football event for Olympics neva comot for dia training base for Atlanta, USA.

Na for 2am midnite de Dream Team VI go follow Japan play on Friday but dem still tanda for Atlanta like bird wey no fit fly.

De oga bosses for de team dey hope say dia chartered flight wey suppose carry dem go Manaus for Brazil, wia dem suppose play dia first two matches, go arrive very soon.

“Nawa o! I surprise say team wey suppose play on Friday neva still comot from USA,” former Super Eagles player, Sam Sodje relate African Football.

“Pipu wey dey in charge of dis team welfare neva try at all and make dem no expect miracle when de competition start.”

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x