9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Ebimobowei don complete one-year deal move go Qatar club

Befor befor Bayelsa United sabi player, Peter Ebimobowei don completed hin move go Qatari club Al-Mesaimeer Sports Club  from El-Entag of Egypt.

De 22 years pikin comot for Egypt club Al Ahly enta anoda one El-Entag. Now hin don sign one year wit Qatar club and hin don even start training sef.

“I don sign for Al-Mesaimeer Sports Club, de contract na for one year. I don even start to dey train wit de team sef,” naso Ebimobowei relate All Nigeria Soccer.

Al Mesaimeer bin relegate comot from de top league last season as dem kolobi only six points from 26 matches and na dem finish for yansh of the table..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x