9ja FlavourNigeria FootballNigeria Professional Football League

Giwa FC don kolobi Tony Ogharanduku as coachie

Afta dem enta Naija Professional Football League (NPFL) back as League Management Company (LMC) take gree make dem com back, Giwa FC don kolobi new coachie wey go helep dem for remaining of dis season. De guyman name na Tony Ogharanduku.

LMC bin chase Giwa FC comot for league befor becos dem no honour three matches for inside de season and dem no give beta excuse for am. But Giwa don get court order now wey LMC need to obey com tell dem make dem comeback.

Giwa FC announce ontop dia Twitter as dem sign de new coachie wey don work for Enyimba FC and FC Taraba befor.

Tony suppose start work for Giwa FC immediately as per order wey ogas at de top don give am..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x