9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Igboun tear net to helep UFA win match for Russia league

Super Eagles striker Sylvester Igboun tear net wit de only goal for FC UFA as dem waya Krylya on Friday inside Russian league game.

De match bin get as e be and goal no gree com until 83 minute when UFA get penarity and na de Naija pikin go play am. But hin no do mistake as hin tear net wit de goal and na hin UFA use win 1-kondo.

De Russia club bin finish de match wit only 10 man after Pavel Alikin chop red card for 88th minute.

Na Igboun first goal for UFA dis season be dis as hin score 4 goals last season..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x