9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Iheanacho na No. 9 best & most expensive U-21 players for world

Naija and Manchester City sabi small pikin, Kelechi Promise Iheanacho, don enter list of 10 ten players wey dey below 21 years wey get value pass as Soccerex take yarn am.

Iheanacho dey number 9 for de list wey get Man Utd player Anthony Martial as dem oga boss for de list as hin worth €47.150 million.

soccerex-nacho

Iheanacho, wey bin tap ball for Man City for dem padi-padi match wey dem lose 1-kondo to Bayern Munich on Wednesday, dey number 9 becos hin worth €20.066 million (£16.8m).

Schalke small pikin player Leroy Sane na number 2 and Bayern Munich new pikin wey just carry Euro Cup wit Portugal Renato Sanches dey number 3.

Oda pipu wey dey for Iheanacho front na Dele Alli, Kingsley Coman, Embolo, Marcus Rashford plus including Max Meyer..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x