9ja FlavourNigeria Football

Iheanacho tear net wit beta goal as Super Eagles waya Tanzania

Naija Super Eagles waya Tanzania 1-kondo for match wey sweet wella on Saturday for inside Godswill Akpabio international stadium, Uyo.

Na Gernot Rohr first match as coachie of Naija be dat and e tough for de strikers of Naija to score as dem try dia best to score since match start. Na for 78 minute Kelechi Iheanacho tear net wit beta shot from outside box 18 wey Naija com win finally.

Na de goal be dis:

Naija and Tanzania don kuku ja comot from de qualifiers for 2017 AFCON so de match just be like play-play but Rohr still take am serious as per de match go determine how pipu go dey look am as coachie.

All de players wey start for Naija play wella and de defense make sense wit William Troost Ekong and Leon Balogun for centre back.

Naija next journey now na for World Cup qualifier and na Zambia be dia first enemy for dat level..

 

Photo Credit: Twitter/@TheNFF

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x