9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Isaac Success don kolobi work permit to tap ball for Watford

Naija small pikin striker Isaac Success don kolobi work permit to tap ball for hin new club Watford FC.

As per amebo wey Sports Ration gather, United Kingdom authority pipu bi grant am de permit on July 13 but hin collect de document on Tuesday, July 26.

Success neva tap ball at all for Super Eagles of Naija but to get work visa na moi-moi for de guyman.

De befor-befor Granada player fit play hin first Premier League match for Watford when dem wear one trouser wit Southampton on August 13..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x