9ja FlavourNigeria Football

Mikel deny tori say hin helep Dream Team VI wit $30K

Naija sabi midfielder and skippo for U-23 team, John Obi Mikel don yarn all man say na lie be all de tori say hin donate $30,000 to take helep hin Olympic team mates befor Rio 2016 Olympic games wey go shele for Brazil.

Amebo bin dey go round for Naija wella dis week say Mikel bin helep hin team mates wit money wey dey around N30m as NFF and Sports Ministry dey cry say money no dey.

Mikel, wey also be skippo for Team Naija to the Rio Olympics, na one of de two over-age players dem wey Samson Siasia carry go Rio.

“Na my friend bin tell me about de tori from Naija,” Mikel relate from camp for Hyatt Place. “I bin tink say na play-play o until hin send me link to de tori.”

“I no know pesin wey tell dem dis kain tori o. Na de kain tin wey dey break team be dis. I tink say na tori wey go dey unite us as team suppose dey comot for media nah.

“We target for Rio na to make am wella but if dem continue wit all dis kain tin I dey wonder how we wan unite do am o.

“As for me ehn, na just distractions all dis tins be and e no go helep us as team for Olympics.”

Naija dey de same group wit Japan, Sweden and Colombia as dem dey try to win gold as dem take do am 20 years ago for Atlanta..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x