9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Mikel dey leave Chelsea to go Besiktas for £7.7m?

E be like say Super Eagles skippo John Obi Mikel don finish hin work for Chelsea as per amebo wey Sports Ration dey get say Besiktas don dey try toast am comot.

Besiktas don start to dey follow Chelsea yarn ontop Mikel mata and Chelsea don yarn say dem want £7.7 million for de 28 years pikin.

John-Obi-Mikel-686848

Mikel don win plenty trophies for Chelsea inside de 10 years wey hin dey dia. UEFA Champe League, Europa League, two Premier League, four FA Cups and two League Cups na all de cup wey Mikel don carry for de London club.

Besiktas qualify for UEFA Champe last season after dem win dem Super Lig for Turkey and dem dey find beta sabi midfielder wey get beta experience to helep dem go far for Europe.

Na only one year remain ontop Mikel contract for Chelsea and Antonio Conte never open mouth ontop hin future for de club, na wetin dey make all man think say hin work fit don finish for London be dat..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x