9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Mikel don finally change hin name for official level

Super Eagles skippo, John Obi Mikel don finally change hin name officially after mistake wey shele since 13 years ago.

Mikel go like make dem dey call am Mikel John Obi now for all hin documents wey hin dey use like drivers license.

Dem bin born Mikel as John Michael Nchekwube Obinna but na for 2003 FIFA Under-17 World Championships pipu for Naija Football Association (NFA) do mistake go submit hin name as “Mikel” instead of  “Michael” for de tournament wey shele for Finland.

As per say de guyman do well for de tournament and pipu don dey know am wit de name hin kuku accept Mikel as hin name dey use dey go but hin neva change am officially since then.

As per amebo wey we gather for UK Evening Standard, de 29 years pikin don do all de paper waka ontop de change of name.

Mikel dey wit Naija Olympic team for Brazil and na hin be skippo for de Dream Team VI wey go tap dem first ball against Japan on Thursday..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x