9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Mikel sleep wit hin Rio 2016 bronze medal

Dream Team VI skippo, Mikel John Obi don confess say hin sleep wit hin bronze medal wey hin win afta Naija flog Honduras for third place match inside men’s football event of Rio 2016 Olympics Saturday night.

Naija U-23 beat Honduras U-23 3-2 on Saturday to win bronze and dat one na de only medal wey Naija win for Brazil for de Olympics de dat.

For article wey hin write for Evening Standard, Mikel reveal say him no fit off de medal for neck after him and hin teammates don jolificate finish. he slept in his bed with his bronze medal.

“Wen I wake up inside my hotel room on Sunday mormor, I open eye and I see my Olympic bronze medal dey tanda beside me dia,” the 29 years pikin relate.

“Naso I remember say I don achieve beta tin wit my teammates for dat last night.”

Photo credit: ESPNFC

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x