9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Moses get No.15 for Chelsea, Mikel still go wear 12, Ola Aina & Tomori sef get numbers

Naija sabi striker Victor Moses go wear number wey Didier Drogba bin drop when hin dey Chelsea dis season.

De jersey number 15 for Chelsea na jersey wey Drogba don make popular wella becos of de beta wey de Ivory Coast pikin do when hin dey de London club.

Moses bin don wear number 20 and 13 befor for de club and hin don do Ajala travel wella as hin go loan to Liverpool, Stoke, and West Ham United.

Meanwhile, Naija skippo wey dey Olympics now now, Mikel John Obi go still dey wear hin number 12.

Oda Naija pikins wey dey Chelsea na Ola Aina and Fikayo Tomori and dem go gather wear number 34 and 33 like dat..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x