9ja FlavourNigeria Football

Naija don climb FIFA ranking ladder reach no. 67

Super Eagles of Naija don climb FIFA ranking from 70th wey dem dey befor to 67th for ranking wey FIFA release for July.

Naija now dey for number 16 for CAF ranking.

Algeria still dey no. 1 for Africa but dem be 32nd for world. Ghana don takeover Ivory Coast wey win 2015 AFCON waka enter no. 2, now Ivory Coast dey no. 3. Senegal dey no. 4 and Egypt dey no. 5.

For de top 20 change no dey at all as Argentina still dey no. 1 and Belgium for no. 2. Countries wey follow na Columbia, Germany, Chile, Portugal, France, Spain, Brazil and Italy.

Country wey climb de ladder pass na Korea DPR, dem climb 18 places take reach 99th for ranking. And na Cuba dull diasef pass dem dey 151 now and na 30 places dem go down.

Latest CAF rankings:
1. Algeria
2. Ghana
3. Ivory Coast
4. Senegal
5. Egypt
6. Tunisia
7. Morocco
8. Cameroon
9. Congo DR
10. Cape Verde
11. Mali
12. Congo
13. South Africa
14. Uganda
15. Guinea

16. Nigeria

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x