9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Naija striker Afolabi dey joli as hin join body wit Argentina club

Naija striker Afolabi Okiki dey joli say hin don finally join body wit Argentina Primera Division club Talleres de Córdoba ontop one-year deal parol.

De befor befor Flying Eagles player, wey bin make sense wella for Sunshine Stars, enta de Argentina club proper proper on transfer deadline day on Wednesday.

Although de transfer bin get as e be but de befor befor Shooting Stars goalscorer still dey joli.

“My belle dey totori me as I dey dis club now becos hin bin reach one level wey I dey doubt if e go happen,” hin yarn Complete Sports.

“Na time no pay my new coachie back say hin believe in me and I pray say I go score goals wella for de club.”

De Naija sabi man, wey tear net 13 times for Sunshine Stars dis season, go make hin debut when Talleres wear one trouser wit River Plate..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x