9ja FlavourNigeria Football

We never enter deal wit NNPC o! – NFF

 

De Naija Football Federation (NFF) don yarn all man say na lie o, dem never follow Naija National Petroleum Corporation (NNPC) enter deal ontop salary for new Super Eagles coachie.

Amebo wey dey sonch for Naija since last week bin dey claim say NFF don enter $1.5 million deal wit NNPC to take dey pay salary and alawi of new coachie wey Naija go get.

download

But Honourable Suleiman Yahaya-Kwande, who be Chairman for NFF Media and Publicity Committee open mouth yarn all man say de tori na lie.

“All dis tori say we don chook biro inside paper wit NNPC na big lie o. De writers just wan write anytin na why,” hin relate.

“But we go really joli wella if e fit happen o. We still dey try to toast companies wey go helep us wit de salaries and alawi sha.

“But we (NFF) never enter any deal wit NNPC o. Make all man know now.”

NFF get three coachies for dem shortlist. Dat one na Salisu Yusuf, Tom Saintfeit plus including Paul Le Guen.

And Sports Ration don gather am confam say de Technical and Development Committee go do interview for de three of dem on Monday, July 18, and NFF executive committee go com later let all man know who be de new coachie..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x