9ja FlavourNigeria Football

NFF don announce Paul Le Guen as new Super Eagles coachie, but comma dey!

Naija Football Federation (NFF) don yarn all man say dem don choose Paul le Guen as technical adviser for de Super Eagles of Naija and de man go follow we own Salisu Yusuf work.

Le Guen wey 52 years pikin don work for Lyon, PSG and Rangers befor and hin be befor befor coachie for Cameroon and hin qualify dem for 2010 World Cup.

https://twitter.com/thenff/status/755096620241477632

Naso NFF put am for dem official twitter account yestaday (Monday).

Dem even also yarn say Salisu Yusuf na hin go be chief coachie among other informate wey dem sonch for twitter.

https://twitter.com/thenff/status/755096620241477632

https://twitter.com/thenff/status/755098658870272001

But de tin be say NFF never finish all de talk talk ontop contract agreement wit de Frenchman. In fact sef, Sports Ration don gather from France wey som pipu even dey carry amebo say Le Guen no go gree sake of say no be wetin hin want NFF wan give am for de contract.

Na de meaning of wetin de French amebo man yan be dis below for oyinbo:

But sha, NFF don announce am wit confido and na wetin we go put for head for now be dat.

All Naija pikin wey dey gbadun football need wait till when NFF go unveil le Guen finally abi one strong report from Le Guen hinsef say hin don sign de contract.

Hin first job na to qualify Naija for 2018 World Cup wey go shele for Russia as hin take helep Cameroon do am for 2010 World Cup.

Super Eagles dey de same group wit Algeria, Cameroon and Zambia..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x