9ja FlavourNigeria Football

NFF don kolobi $1.5m deal wit NNPC to take dey pay new Naija coachie

According to amebo wey dey circulate for Naija media, Naija Football Federation (NFF) don kolobi deal wey waka reach $1.5 million to take dey pay new oyinbo coachie wey dem go get for Super Eagles of Naija.

According to amebo wey dey ontop African Footballna NNPC wey be oga boss for oil companies for de country na dem go dey comot money pay de coachies salaries.

541541

Federal Government don draw hear for NFF yarn dem say dem no get hand for inside to dey pay de salary of de coachie again o. And de Minister for Youth Development and Sports, Solomon Dalung, sef don yarn dem say government no go even look dem side again ontop payment issue.

NFF still dey owe some of de coachies wey don work for Naija and dem don promise say dem go pay de salaries wit de ogbonge deal wey dem don kolobi wit NNPC.

De technical committee of de organisation wey dey run tins for Naija football bin release names of pipu wey fit get de Super Eagles job last week. Oyinbo coachies like Paul Le Guen and Tom Sainfeit plus including Naija own Salisu Yusuf dey de three man shortlist and dem yarn all man say by Monday (today) dem go don know who ripe pass to coach Naija inside de three.

De new coachie go get beta mountain to climb since na World Cup qualifiers in go go play straight wit Naija team wey be like say e get K-leg right now. And de fact say group wey Naija dey hard like Olumo rock no helep mata at all.

Super Eagles dey de same group wit Cameroon, Algeria and Zambia and dem go start to dey ball against Zambia for October 3..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x