9ja FlavourNigeria Football

NFF wan finish Siasia career if hin no shut up

One oga boss for Naija Football Federation (NFF) don warn coachie Samson Siasia say make hin beta stop to dey yarn anyhow about wetin hin face wit Under-23 team or dem go finish hin career for am.

Afta de befor-befor caochie of Super Eagles carry Dream Team VI go win bronze for Rio 2016 Olympics hin resign as coachie and hin open mouth yarn about all de tins wey him and hin team face for Brazil and how e no make sense but one official for NFF dey warn am o.

“We just dey sidon look Siasia dey talk anyhow. We sef get our own tori to yarn o. Make hin no forget say our failure for Africa Cup of Nation start wit am,” naso de oga boss yarn Own Goal Nigeria.

“Hin be ingrate. Na we dash am opportunity to start hin career again wit U-23 but hin show us say na de same person hin be. We know how hin take select players for de two matches wey hin coach Super Eagles o. Make hin beta shut up.

“We get facts say hin get hand for som wuruwuru wey no make us go AFCON and we receive petition ontop hin head pass any other coach.

“If hin no shut up we go end hin career.”

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x