9ja FlavourNigeria FootballNigeria Professional Football League

NPFL: Enyimba waya Akwa United two times (home and away)

Enyimba FC claim oga boss ontop Akwa United for dis season Naija Professional Football League (NPFL) afta de Elephants waya dem 2-1 for Yakubu Gowon stadium, Port Harcourt on Saturday for match day 33 match.

Na de second time wey Enyimba go flog de Promise Keepers be dis as dem also chop am for first leg wey shele for Uyo 1-kondo.

E don be like say say Mfon Udoh don swear say hin no go tear net for league again but hin no dull for de match. Na from 9 minute hin don helep de Elephants score from penarity as scores change to 1-kond0.

Akwa United fight wella to enta match back and dem chop dia cake for 44 minute as Hassan Babangida tear net for dem and dem start to dey joli.

De Uyo club been defend wella to stop Enyimba attack for de match but e no reach as Ikechukwu Ibenegbu wey be substitute for de game carry ball tear net from free kick wey hin play for just ten minutes wey dey remain for de match.

Enyimba now don climb table reach number 5 wit 48 points and dem still get beta hope to go CAF Champions League next season..

 

Photo credit: @LMCNPFL/Twitter

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x