9ja Flavour

NPFL Matchday 25: Wikki still be ‘oga boss’, MFM FC waya Ikorodu for Lagos derby

CmeVnxyWYAQlguk
The Lagos derby (c) @LMCNPFL/Twitter

Wikki Tourists still dey ontop of Naija Professional Football League (NPFL) table as oga boss after matchday 25 games wey shele on Saturday and Sunday.

Wikki follow Enugu Rangers play kondo-kondo draw as no goal enter net to separate dia fight for Bauchi on Sunday.

As e be for de two clubs now, Wikki don gather 42 points after 24 games and Rangers get 40 points.

For Lagos, MFM FC pour sand-sand inside Ikorodu United garri as dem kpokpo de Oga boys 3-1 for Agege Stadium on Sunday. De Lagos Derby bin make sense wella as many pipu com watch am plus including governor of Lagos state, Akinwunmi Ambode.

Sikiru Olatunbosun na hin first score for MFM inside 12 minute and skippo for Ikorodu equalise wit penarity Fatai Abdullahi as first half finish 1-1.

MFM FC bin no let Ikorodu United shack water at all for de second half and dem tear net lead again for 70 minute. Na Stephen Odey tear net for dem. But Ifeanyi Ifeanyi later close shop finally for injury time wit correct penarity wey hin use tear net as scores be 3-1 when match finish.

For Umuahia, Plateau United surprise all man as dem waya Abia Warriors inside dem backyard 1-kondo. De three points wey dem tiff comot from Abia state make dem climb comot from relegation zone.

Na all de score for matchday 25 be dis:

FC Ifeanyi Ubah 0-0 Sunshine Stars

Enyimba FC 2-0 El-Kanemi Warriors
(Anaezemba 53′ – Bassey 69′)

Lobi Stars 2-0 Heartland FC
(Okpotu pen. 24′, Own Goal 80′)

Akwa United 2-1 Kano Pillars
(Paterne 77′, Yusuf 87′ – Gyang 55′)

Abia Warriors 0-1 Plateau United
(Johnson Ibeh 24′)

Wikki Tourists 0-0 Enugu Rangers

Niger Tornadoes 2-0 Warri Wolves
(Issa 18′, Musa 65′)

MFM FC 3-1 Ikorodu Utd
(Sikiru 12′, Odey 70′, Ifeanyi pen. 90+3′ – Oluwadayo 20′)

Saturday –
Nasarawa United 1-0 Rivers United
(Bashir 60′)

CmdaGVKXEAAyq37

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x