9ja FlavourNigeria FootballNigeria Professional Football League

NPFL All-Star chop am for Malaga hand, dem go play Atletico for third place

Naija NPFL All-Star team chop am for Malaga CF hand for de semi final of Carraza tournament wey shele for Spain on Friday for dia La Liga tour.

Na 4-1 Malaga use do Naija strong tin for de match.

De Naija league All-Star team bin lose 2-1 to Valencia for play-play match wey shele befor dis one but som beta sabi players wey tap dat Valencia match bin no dey for Malaga own.

Na Kusmanovic first tear net for de match for Malaga for 22 minutes befor Ismaila Gata fire shot and Wellington score own goal. Naso NPFL All-Star equalise for 32 minutes but big wahala dey front dey wait dem.

Befor befor Barcelona player Sandro Ramires tear net two times and Youssef Nyeri close shop finally to make scores 4-1.

De 5 Enyimba players wey comot for NPFL All-Star camp go play for CAF Champe match no helep Salisu Yusuf at all.

Now dem go follow Atletico Madrid tap ball for de third place match on Saturday..

Photo credit: @LMCNPFL/Twitter

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x