9ja FlavourNigeria FootballNigeria Professional Football League

NPFL All-Star end La Liga tour wit flogging from Atletico Madrid

The Naija Professional Football League (NPFL) All-Star team finish dia tour to La Liga after dem chop cane from Atletico Madrid for third place match of de Carranza tournament on Saturday.

De Spain team waya de boys from Naija 2-1 for Cadiz and dat one make am 3 matches wey dem lose since dem land for Spain.

Na Argentina pikin Nicolas Gaitan first tear net for Atletico for 33 minutes, and Abdulrahmam Bashir equalised for NPFL for 84 minute.

E wan be like say dem go even draw one match since dem don dey chop am for pipu hand since but Diego Godin winchi dem and hin no let am happen.

Na so de Uruguay pikin go tear net for 89 minute to take win am for Atletico.

De tin dey pain wella becos NPFL All-Star really bin wan win one match comot from Spain even after dem chop 2-1 for Valencia hand for play play match and dem chop 4-1 for Malaga hand for de semi final of Carranza tournament..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x