9ja FlavourNigeria FootballNigeria Professional Football League

NPFL title don dey level for us to carry now – Imama Amapakabo

Coachie of Rangers International FC, Imama Amapakabo don yarn say hin get confido say hin club fit carry Naija Professional Football League (NPFL) cup dis year after dem waya Rivers United 4-kondo on Sunday.

De Flying Antelopes climb table reach number 1 back afta dem win on Sunday, now dem get 54 points afta 32 games wey dem don play.

Imama de follow Complete Sports wen hin talk say: “No doubt at all na beta win for us, now I get confido say we fit win de cup.

“Na four tough games remain for ground for us befor league finish and I sure say we fit do am.

“E don tey wey we carry dis cup and time don reach to carry am again. We don try wella dis season.”

De Enugu club wey don carry NPFL title six times go continue dem challenge next weekend wen dem face Shootings Stars for Ibadan..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x