9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Oshoala tear net for Arsenal Ladies for league

Super Falcons sabi player, Asisat Oshoala helep Arsenal Ladies flog Notts County 2-kondo for Meadow Lane inside Women’s Super League on Sunday.

Oshoala bin don dey try score since match start wit beta performance for de game until 47 minute wey she dribble keeper com tear net.

Arsenal Ladies bin later chop red card but dat one no stop dem from beating Notts County as dem score anoda one wit own goal wey Notts goalie do.

So as e be now for league, Manchester City dey first wit 35 points and Arsenal Ladies dey 3rd wit 23 points..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x