9ja FlavourNigeria Football

Presido Buhari don yarn Dream Team VI say make dem carry gold com house

Naija President Muhammadu Buhari don hail de Dream Team VI of Naija wey dey do beta for Rio 2016 Olympics for Brazil and hin don yarn dem say make dem try carry gold medal com house like how Naija do am for Atlanta 1996.

Naija don graduate enta semi of de football event wey dey shele for Brazil after dem waya Denmark 2-kondo and dem go jam Germany for de semi on Wednesday.

 

Hin yarn through hin media adviser, Femi Adesina: “Again and again, naso we Olympic Eagles dey waya pipu go. Dem dey show all de world as Naija pipu take strong like concrete.

“Dis na team wey no man give chance o. But now dem dey for semi final. Make una do am for us. Make una go for gold. And make dat Naija banner fly wella again. We don almost reach dia. Make we do am abeg,” naso Vanguard yarn am..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x