9ja FlavourNigeria FootballNigeria Professional Football League

Rangers climb table to No.1, Wikki draw Tornadoes as Enyimba waya Pillars

Rangers International don sempe for top of Naija Professional Football League (NPFL) table after Wikki Tourists no fit flog Niger Tornadoes for Lokoja and dem play 1-1 draw.

Rangers bin don flog Akwa United 3-2 for dem backyard for Uyo on Saturday for first match wey shele for match day 27.

CngyGBTXYAACh4o
Rangers players dey joli after dem tear net. (c) @LMCNPFL/Twitter

De Flying Antelopes now don kolobi 46 points from 26 matches but Wikki dey second and na just two points dem use dey junior for Rangers.

For de big jagabans fight on Sunday, Enyimba bin waya Kano Pillars 2-1 to take

In a battle between the past two winners of the NPFL title in the last four years, Enyimba FC defeated Kano Pillars 2-1.

NPFL‬ Match Day 27 Results:

Saturday, July 16, 2016-

Akwa Utd 2-3 Rangers
Nasarawa Utd 3-0 Sunshine Stars

Sunday, July 17, 2016-

Rivers United 2-0 Shooting Stars (3SC)
FC Ifeanyi Ubah 1-0 El-Kanemi Warriors
Lobi Stars 1-0 Plateau United
Abia Warriors 1-0 Warri Wolves
Niger Tornadoes 1-1 Wikki Tourists
MFM FC 2-0 Heartland FC
Enyimba FC 2-1 Kano Pillars

CnliLAsXgAACNWu
League table after match day 27 games wey shele on Saturday & Sunday. (c) @LMCNPFL/Twitter

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x