9ja FlavourNigeria Football

Rio 2016 Football: Naija go fight Honduras for bronze today

Naija go follow Honduras fight for bronze medal today (Saturday) for men’s football event of Rio 2016 Olympics wey dey shele for Brazil.

Germany bin waya de Dream Team VI 2-kondo on Wednesday night to enta final go tap ball wit Brazil.

 

Hin bin pain coachie Samson Siasia wella as Naija lose and hin yarn say na mistake wey de players make cos am.

“Mistake plenty for de game. My players just dey dash dem opponents ball for de match jare. If you dey do like dat you no fit win match nah,” Siasia relate after de match.

“We go play dis third place wit beta seriousness o. E beta make we beta carry bronze pass make we go house wit notin.”

 

As e be now, midfielder Okechukwu Azubuike wey no tap de last match don well and hin go play Honduras on Saturday. But Oghenekaro Etebo neva still well to play and Naija go miss am.

Honduras bin chop am wella for Brazil hand 6-kondo for dia own semi against Brazil.

De Nigeria v Honduras match go shele for Mineirão for 5pm..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x