9ja FlavourNigeria Football

Rio 2016 Olympics Table Tennis: Chinese Taipei Ma Long ja Aruna Quadri for just 28 minutes

Chinese Taipei pikin wey be world number 1 for table tennis, Ma Long no waste time throway Aruna Quadri from dis year Rio Olympics for quarter-final match wey shele on Tuesday.

Na for just 28 minutes na hin de Chinko waya Quadri wey be de first African wey go graduate reach quarter final of men’s table tennis event for Olympics.

Quadri bin don flog Chih-Yuan Chuang of China (No. 5 for world) for de third round take waka enter round of 16 wey hin also waya Germany pikin Boll Timo.

But de kain beating wey hin chop for Ma Long hand no be for here o. De scores end for 11-4, 11-2, 11-6, 11-7. Quadri no even win one set sef.

 

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x