9ja FlavourNigeria Football

Rohr release 23-man list for Tanzania match, Mikel & Musa dey dia

Super Eagles new coachie, Gernot Rohr don release hin first list of players wey go tap ball for Naija for dia 2017 AFCON qualifiers against Tanzania wey go shele for Saturday, 3 September. 2016.

Naija and Tanzania don already ja comot for next year AFCON wey go shele for Gabon but Rohr still call all de sabi players wey fit tap ball for Naija for de match. Players like skippo Mikel John Obi, Ahmed Musa and Carl Ikeme dey de list.

Imoh Ezekiel wey tap ball wella for Rio 2016 Olympics wey still dey shele sef dey de list wit Maccabi Tel Aviv midfielder, Nosa Igiebor. Rohr holla Victor Osimhen sef.

But de Germany coachie dey use de match to take cook de team wella for 2018 FIFA World Cup qualifiers wey dey start for October dis year.

De AFCON qualifier match go shele for Akwa Ibom International Stadium, Uyo on Saturday, 3 September.

DE FULL LIST OF INVITEES:
Goalkeepers: Carl Ikeme (Wolverhampton Wanderers, England); Emmanuel Daniel (Enugu Rangers); Ikechukwu Ezenwa (FC Ifeanyi Ubah).

Defenders: Leon Balogun (FSV Mainz 05, Germany); William Troost-Ekong (Haugesund FC,Norway); Chidozie Awaziem (FC Porto, Portugal); Jamiu Alimi (Kano Pillars); Abdullahi Shehu (Uniao da Madeira, Portugal); Musa Muhammed (Istanbul Basaksehir, Turkey); Elderson Echiejile (AS Monaco, France), Kingsley Madu (AS
Trencin,Slovakia)

Midfielders: Mikel John Obi (Chelsea FC, England); Ogenyi Onazi (Trabzonspor, Turkey); Wilfred Ndidi (KRC Genk,
Belgium); Nosa Igiebor (Maccabi Tel Aviv, Israel)

Forwards: Ahmed Musa (Leicester City, England); Kelechi Iheanacho (Manchester City, England); Moses Simon (KAA Gent, Belgium); Victor Moses (Chelsea FC, England); Imoh Ezekiel (Al Arabi Sporting Club, Qatar), Odion Ighalo (Watford FC, England); Brown Ideye (Olympiacos FC, Greece); Victor Osimhen (Wolfsburg FC, Germany)

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x