9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Sone Aluko dey joli wit Fulham transfer

Naija sabi player, Omatsone Aluko don finally yarn ontop how hin belle dey totori am to join body wit Fulham wey dey tap ball for English Championship.

Aluko join Fulham ontop two-year deal wit option say hin go dey de club for anoda one year after hin contract finish for Hull City.

7

De guyman don yarn all man ontop why hin comot from Hull after 4 seasons for de club.

“I dey joli wella for here. All de paper wahala don comot for road now na time to do work proper.

“Time don reach make I show wetin I fit do.

“De coachie SlaviÅ¡a Jokanovic don let me know wetin hin want dis season and how hin wan take play. And wetin hin yarn na part of my plan sef so e make sense wella,” naso Aluko yarn de Fulham website.

Aluko don tap ball for Naija seven times and hin tear net two times for Super Eagles..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x