9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Standard Liege don borrow Echiejile from Monaco

Naija defender Elderson Echiejile don go Standard Liege for de rest of dis season from Monaco as de Belgium club borrow am for transfer deadline day on Wednesday night.

De 28 years pikin neva play even one match for Monaco dis season as hin just dey chop bench anyhow since Layvin Kurzawa don enta de club from PSG last year.

Echiejile don tap ball 50 times for Naija and hin dey wit Super Eagles team for Uyo for de AFCON qualifier wey Naija wan play wit Tanzania dis weekend.

Hin bin dey for SC Braga for 3 and a half season befor hin enta Monaco for 2014.

 

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x